Brymo - Illusions lyrics

[Brymo - Illusions lyrics]

You carry boyi go yonder, you say he no go oh
Slavers boku round town hin
Brother tell am oh
Stand for your ground
Make you no hurry follow go
Them dey sell people troway
My brother no go oh
The people them wey go river
Them never return oh
Them say na mami water carry everybody go oh
For full moon
Papa go farm he never return oh
Them say na the forest carry am swallow oh

Listen boyi, life no balance at all oh
You go place you no know, you no go return oh

Boyi feeling true
Him heart dey beat for the road oh
Him fate na to follow them, follow journey go

Ah ah ah
Wetin I think I become ah
Ah ah ah
Na illusion them dey sell you so

Boyi look forth, him look out
No other place to go oh
He carry him few belongings
Reluctantly follow go
For this life we dey
The things you do you know oh
E better to go reach the place
Find how e dey oh
I talk am
I shout am boyi still dey travel go
Na destiny dey push man where him dey go ah

He try am, he fight am
Urge strong no be small
The tori e dey the place where him dey go ah

Ah ah ahhhh
Na wetin I think I become
Ah ah ahhhh
Na illusion dem dey promise you so

Oga master no wan know value
Pig pass people oh
He say dem be property
With him dog dem equal oh
Boyi clean gun, he shave beard
Oga trust no other
He for adopt boyi, but him people hala
That night boyi take razor he shave am proper
The way Oga dey like am
No touch him moustache ah
Poison for soup
For family and the guards them
He slash master throat too from ear to ear ah

Ah ah ahhhh
Boyi na most wanted for strange country ah
Ah ah ah
He dey gather soldiers ah
From plantations he dey break boys free

Ehn ehn
My people
The main reason we gather here today
Na him concern us now
Na there we dey go next
Ah today on behalf of the
People of the city and
The township, the entire tribe and
Our very very race
We go unveil this statue of boyi
We go give our honorable
Personality himself the
Scissors to use cut the ribbon
For service to humanity and to race
And eh we salute you sir
We salute you well well, because you
Really don touch our lives
You don change our lives from
Generations to generations to come
Nothing go ever remain the same for us
Yes, this statue na the honor
Of your greatness and service
Thank you

Interpretation for


Add Interpretation

Add extended interpretation

If you know what the artist is talking about, can read between the lines, and know the history of the song, you can add interpretation to the lyrics. After checking by our editors, we will add it as the official interpretation of the song!

A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z #
Interpret