Erigga, Dr. Barz - Street Motivation lyrics

[Erigga, Dr. Barz - Street Motivation lyrics]

As I dey find money no dey swear for me
Unless you get money

Person no dey shout for me

Everyday I say na red eye
Like a traffic something
Na green light we dey find
For the traffic something

Person when shit for church
Use Bible clean yansh
Say you wan pray for me, armed robber motor
You when dey use people
Head carry big-big yansh
Say make I sow seed give you
You cut am for mouth oh
Been on the street too long
I know when girl dey cheat
She run leave her boyfriend because
He no dey pick no go let
"I too like am" make you drink sniper
Come go die, I dey call you
Now you no dey pick
The best advice na the one
When you give yourself
Nobody go believe you if
You no believe yourself
All wetin they take stone me
I use am build career come build barrier
Incase they wan come reno me
As for all those doors wey
Una shut on my face
I dey come buy the building, e no pass 108
Small challenge, I don write am give my pa
E no reach am too, you suppose know my papa
Na God

Everyday I say na red eye
Like a traffic something
Na green light we dey find
For the traffic something
Everyday I say na red eye
Like a traffic something
Na green light we dey find
For the traffic something
Powered by Rubicon Project

No put me for ground, abeg I no wear pants oh
Na me dey make money but na you dey count oh
Agbero don rank me up, Erigga buy beer
Na only you dey give us joy
We ready kpai here
Do you believe in God, or you just dey form?
The church when you dey come na
Make you for no loose guard
No be to dey nice to me
What about the waiter when you dey shout for
Meaning you fit still shout for me
If I no be Erigga or see money like you
Drive Benz, get level, everywhere stew
Life na game of whot
Halla last card first na
Pick two, pick three, no love for the denkwe
For this industry
Na fake love all of them dey show
This album wash, no artist here go post oh
I understand una fear, say I wan take over?
Well, fuck it
It's time Erigga take over abeg

As I dey find money no dey swear for me
Unless you get money
Person no dey shout for me

Everyday I say na red eye
Like a traffic something
Na green light we dey find
For the traffic something
Everyday I say na red eye
Like a traffic something
Na green light we dey find
For the traffic something

Interpretation for


Add Interpretation

Add extended interpretation

If you know what the artist is talking about, can read between the lines, and know the history of the song, you can add interpretation to the lyrics. After checking by our editors, we will add it as the official interpretation of the song!

Latest added interpretations to lyrics

A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z #
Interpret