Solidstar - Confused lyrics

[Solidstar - Confused lyrics]

Ohhhh yeah ohhh ah yeah yeah
Story of a long time paddy, paddy
Na my best friend
I jam am for my room with my girlfriend
And she dey pretend wey dey don hammer
Dey don show their skills well well
If dey tell me say na you wey go do like this
I go say lai lai eh i know no say na you
Be the devil wey dey put
Sand sand for my eyes eh
Tell me wetin I do you
Wey dey make you dey scatter
My fam like thesе and na you be the one wеy
I call my bestfriend eh no no no
If na you wetin you go do o, no no
Me I dey confused
I no know wetin to do ohhh, no no
Tell me if na you wetin you go do
Me I no know wetin to do
Cause I dey confused
Ahahahahaha me I dey confused
I no know wetin to do
This na another true story
Of two strong paddy paddy
No be small tory eh
Cause this life wey we dey
If you do good for your paddy
Na evil e go pay you eh
Imagine say your friend wey you love
Con dey hook you for neck
Tell me how you go feel eh
This na why johnny kill him paddy
Because of hin baby hin paddy dey fire eh
I don see I don tire for this life
Cause this paddy paddy matter
Wan dey make me to dey cry
I dey cry soote water nearly
Finish for my eyes
Cause na you be my trusted friends oo
If na you wetin you go do o, no no
Me I dey confused
I no know wetin to do ohhh, no no
Tell me if na you wetin you go do
Me I no know wetin to do
Cause I dey confused
Ahahahahaha me I dey confused
I no know wetin to do ahahahahaah
See my best friend na my baby boo
Them dey play me for a fool for my back
Dem dey call me mugu ehh
Dem be dey tell me but I no believe
Cause na you be my friend
Wey I take as my family my own paddy
If dem tell me say na you
Wey go do me like these i go say lai lai eh
I no know say na you
Be the thief wey come rub for my house
Last night eh tell me wetin I do you
Wey dey make you put finger for my eye eh
Jonny ehhhh if na you
Wetin you go do o, no no me I dey confused
I no know wetin to do ohhh, no no
Tell me if na you wetin you go do
Me I no know wetin to do
Cause I dey confused
Ahahahahaha me I dey confused
I no know wetin to do
Me I no know wetin I go do eh
Ahh me I dey confused i kno no wetin to do
Dey stab me for back eh johnny eh
See as you dey stab me for back eh
For my baby
Before you be my one in a million million
Ehhehehe
Na you be the be the last in a million
You the last in a million girl
Solid star say so

Interpretation for


Add Interpretation

Add extended interpretation

If you know what the artist is talking about, can read between the lines, and know the history of the song, you can add interpretation to the lyrics. After checking by our editors, we will add it as the official interpretation of the song!

Latest added interpretations to lyrics

A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z #
Interpret