Victor AD, Erigga - Area To The World lyrics

[Victor AD, Erigga - Area To The World lyrics]

Abeg! Omo e get weytin i just dey
Observe ehn for this industry
It’s Victor AD nahnah ye e it’s paperboi
Motivate yourself men Area! The Erigma

E pain me say na wen I
Go na hin everywhere burst
People wan know if na true
Dey check Insta blog
Rappers dey throw backie happy
Wan kill dem die
As Erigga no dey again people go feel dem die
Even rappers wey no dey post my song before
Fake love don put me
For their profile picture
They screenshot their dm wen I dey write dem
Say make we run feature see me see problem
Followers don increase go 15 m
OAP since morning dey jam me for Fm
My videos wey soundcity no gree accept
Dey on every rotation even my concert
Na so e for be but oluwa forbid
My song go speak for me anyhow e be
Who go better go better na time e go take
Day break everywhere burst for goodness sake

I say tell dem the full story but
Dem no dey believe o eh
No matter how you watch film d
Story inside no fit change o
I be dey give dem the full load down
But but dem no believe o eh
Who God don bless world people
No fit change o

Area o, area o, area o ehh (Warri to d world)
To the world o, to the world o
To the world o eh
Area o area o area oo eeeh (Paper boy Abeg)
To the world o to d world to d world o eeh

I remember wen I no get bar
That year na wen I dey de edjeba
Madam no meat just put soup with 5 eba
No be enjoyment I come na for survival
No where to go wetin man go do
Na around 2 we dey thief
Fuel from people motor
Dey sell give who get I pass my neighbour
Rechargeable lamp dey listen to omadebo
As e dey give us gist about celebrities
No internet Na him be out everything
I remember when I track am for DBS
Give am my jam e no play am e pain my chest
Because I know d stress wen I don go through
No sponsors sef na money why
U save for school
Na hin I take record am wetin man go do
Give up no join abolie sup wit you

I say tell dem the full story
But dem no go believe o
No matter how u watch film d story
Inside no go fit change o
I be dey tell dem the full load
Down but dem no believe o
Who God don bless world people
No fit change o

Area o, area o, area o ehh
To the world o, to the world ehh
To the world
Area o area o area o ehn (Abeg! Wahala)
To the world o to the world oo to d world

Outro omo see the character
Na only time e go take stammerer
Go call him papa name

Motivate your mothercking self man

Interpretation for


Add Interpretation

Add extended interpretation

If you know what the artist is talking about, can read between the lines, and know the history of the song, you can add interpretation to the lyrics. After checking by our editors, we will add it as the official interpretation of the song!

Latest added interpretations to lyrics

A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z #
Interpret