Erigga, Nosa - GLORY (The Genesis) lyrics
[Erigga, Nosa - GLORY The Genesis lyrics]
You no go believe who dey
There abeg bring Chair
One polo, one Jean, rotten palm slippers
12 years old I don stop to de sleep house
Ring the bell 12 o’clock
Suppose be breaking time
But to me and Kevwe Omo Na taking time
Tear people school Bag remove them belongings
Deep down I don’t know what I’m becoming
Headphone for my ear one old Walk man
De jam 2pac of course I no get work naw
Morning till night we de area de gamble
De struggle Police wear us government bangle
(Handcuffs)
My role model that year Na them bros Ogbe
Na when e die I know say na ole ole
(armed robber)
Community de find us we de Bush de kush
Officer relax, you never know who you de push
My life would have been over
Na baba God de bless me oh e de bless me oh
I no be super man oh but
My life de him hand oh
Na baba God de bless me oh e de bless me oh
When I tell them my dream
Dem go start to laugh
Erigga relax who don blow with rap for Waff
Okere prison de come you go
Soon join your boys
But deep down I know say the
World go hear my voice
From streets to streets de kpuff
Who talk say e dope (rap battles)
Erigga good the problem be say e broke
So when time reach to chose Bible or Riffle
I chose Bible
(skunk wrapped shaped like Bible) flood the
Back streets with kpo (weed)
Money start to enter I begin book session
More video, more show less police station
No more police statement now
Na account statement call dem obor
(his boys) how far how una make that payment
Na the moral for the story give up no join
E fit de hard now country man stay on point
Fail to plan my brother Na plan to fail
Who go better go better Na tay e de tay
No be stone you de cook my brother Na beans
When e done tear everywhere like rugged jeans
I don see men hammer I don see men broke
To the point them no fit
Even fit buy gbana smoke
Who belly full go hungry my brother where you
Na brain Broke today your men
Go throw away you
Money de but I de grind like up coming
Anything when make me fall e no go funny