Erigga, Oga Network - Wahala Dey lyrics

[Erigga, Oga Network - Wahala Dey lyrics]

Wahala dey wahala full here ooo
Country wey blind man dey count money
Wahala dey wahala dey
Wahala full here ooo
Armed robber dey call thief ole ooo
Wahala dey oga DPO na who thief e phone
For inside police station abeg
NEPA office on generator
Dem no know when light go come
As I dey follow you dey talk
All my men done off the loud we dey smoke
You no fit drag am pass one puff
We tire for Nigeria matter I no fit lie you
Na wetin Fela and China talk still dey happen
Who rule go waste money work, he no go do
Hustle done make boys forget wetin
Dem read for school
12 years, 13 years done dey do yahoo
Dey look epa wey no dey do like big malu
Epa done graduate from ekpoma but no level
He find work he tire he kuku join HK
According to am the rain wey beat am today
E go wash he benz tomorrow once he woman pay
All the woman he dey jam no one dey shishi
I no fit judge the story
Long pass deeper life preaching
Since Jona no get patience he join taking
Na last week them poff am
Close to that bakery

Wahala dey wahala full here ooo
Country wey blind man dey count money
Wahala dey wahala dey
Wahala full here ooo
Armed robber dey call thief ole ooo
Wahala dey oga DPO na who thief he phone
For inside police station wahala
NEPA office on generator
Dem no know when light go come
Dear Abacha small thing fit reach me?
The last one you send come
Area no see shishi
Stay at home but where the electricity
Nigeria na cruise I swear
God forbid bad thing
Wetin dey occur my WhatsApp na Mandilas?
"View my status"
Na shoe, bag, hair and slippers
15 years no dey sleep house
She done enter street
Dey sell pus$y for lekki
Her father can′t say shit
Cos na she dey survive dem alert steady
This generation done cast when e go end eee
Na yahoo money make aunty collect big slap
From 17 years old boy them too dey my snap
Nigeria now be like fowl wey no get owner
Who swear for us e no go better for una
Covid-19, graduate wey suppose give us cure
Done turn makeup artist dey
Give director pure

Wahala dey wahala full here ooo
Country wey blind man dey count money
Wahala dey wahala dey
Wahala full here ooo
Armed robber dey call thief ole ooo
Wahala dey oga DPO na who thief e phone
For inside police station
Very big wahala e dey here
NEPA office on generator
Dem no know when light go come
Wahala dey here wahala dey ooo
Wahala dey o o o
See this country wey blind man
Dey count e money oooo
Wahala full everywhere berekete

Interpretation for


Add Interpretation

Add extended interpretation

If you know what the artist is talking about, can read between the lines, and know the history of the song, you can add interpretation to the lyrics. After checking by our editors, we will add it as the official interpretation of the song!

Latest added interpretations to lyrics

A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z #
Interpret